Meet Abraham Lucky Onoja, a former paralympic lifter turn shoe maker wey im picture trend for social media recently and dey ginger pipo.
Abraham for interview wit AfroSky Pidgin say e no dey regret being physically challenged.
Since im picture trend for social media, Abraham wey be shoe-maker tok say order don dey flow in from evriwia.
E also tok say im go like teach oda pipo wey be like am im craft.