To continue using the site you need to read the revised version and agree to the policies
2 minutes, 54 seconds
-1 View 0 Comments 0 Likes 0 Reviews
A WARNING TO REMI TINUBU: POWER DEY SWEET, BUT E DEY FINISH
(10 historical examples)
1. Maryam Babangida – Nigeria
She be like colossus for this country. Better Life for Rural Women scatter everywhere. She fit make or break person career with small phone call. But the day dem comot Babangida for seat, she vanish. All the people wey dey lick boot, even the ones wey dash her honorary degrees, disappear instantly. Power off. Influence off. Silence.
2. Turai Yar’Adua – Nigeria
During Yar’Adua sickness, na she practically run government. Ministers dey kneel down for her corridor. But once oga die, everything evaporate. Her “kingmaker” crew melt like sugar for hot tea.
3. Patience Jonathan – Nigeria
“Na only me waka come” madam wey dey shout for stadium. Governors dey fear her. Contracts dey fly. But once election finish and Jonathan comot, na so her kingdom collapse. Today, na lawyers and EFCC she dey answer.
4. Elena Ceaușescu – Romania
She dey act like goddess. Dem even force scientists to call her “Mother of the Nation.” But when Romanian people vex, dem pursue she and her husband. Trial last few hours. Outcome: firing squad. Power no be forever.
5. Jiang Qing – Widow of Mao Zedong (China)
She control China cultural space as part of the “Gang of Four.” People dey tremble. But once Mao die, dem arrest her instantly. From “Madam Power” to prisoner with life sentence.
6. Imelda Marcos – Philippines
Madam 3,000 shoes. She dey shut down anybody wey block her path. But when the people drag Marcos family down, na exile she land. She go from “queen” to refugee overnight.
7. Marie Antoinette – France
“Let them eat cake” queen wey believe she untouchable. When power shift, nobody remember royalty again. Guillotine no waste time. Her story still dey warn future power-drunk women till today.
8. Grace Mugabe – Zimbabwe
~Friday Reformed (Rant HQ)
To be Continued!